Sunday 22 June 2014

Baba Ibeji comot Dragons for Word Cup

Na Osaze Odewingie score the goal wey give Nigeria victory for World Cup since France 1998 as Naija beat Bosnia Herzegovina 1-0 for Group F clash at Arena Pantanal.


This win now don carry we Super Eagles go second for group F table wey Argetina sit down put for top while Bosnia follow say bye bye to Brazil 2014 after dem don lose two matches.

Ogbonge Super Eagles no look face at all as match start, Mikel and Musa first test Osaze team mate for Stoke City, Asmir Begovic wey dey Bosnia goal post. 

Man City better striker Edin Dzeko for score for that kin 23 minute as he no fit Naija correct keeper Vincent Enyeama in box when Miralem Pjanic give am better pass. 

E no too tey like when Osaze punish Bosnia, Odmwingie nak ball enter inside six yard box when Emenike wey show say him get power well,well give am pass after him ride Bosnia defender.

For inside second half, Bosnia no gree for Naija at all, if you see the way wey this Bosnia boys carry pressure put for Eagles defence fear people well,well but they now gree test Enyeama wey stand for Nigeria goal post gidigba. 

Bosnia keeper, Begovic wake up sharperly for 60minute when Michael Babatunde put shot wey carry plenty fire for body then him still com save another one from Emenike wey for enter goal post. 
Fear catch Nigerians for 77minutes but Enyeama wey dey alert well,well no gree Miralem Pjanic shot from far enter.

Correct guy, Onazi for score in 81 minute but Begovic again dive well to tell ball make e no enter goal. That Onazi hot shot na like from 25 yards.

When that oneass, Bosnia come dey show, they try to score but Joseph Yobo wey captain Super Eagles stand like rock of Gibrata, him with Omeruo no gree for that Naija defence at all, dem just dey clear ball till ref shook whistle put for mouth com blow say match don end.

No comments:

Post a Comment