Wednesday, 11 March 2015

Ujah Dey Ontop “Eran Iya Oshogbo” Level

Cologne sabi striker Anthony Ujah don chop raking ontop how hin take holo de goat wey hin club dey use dey do mascot when hin wan jubilate goal wey hin score when dem waya Eintracht Frankfurt 4-2 for Bundesliga.


Naso Ujah take run 4x40 go grab de goat wey dem dey call Hennes for horn wan climb am like horse after hin score goal wey change scores to 4-1.

Sharp sharp after de match de guyman run go Instagram go dey beg de goat ni o. Becos dem talk say de goat dey vex ontop say Ujah wan climb am (You sef talk “shoooo” abi? Naso we hear am).

No be de first time wey Ujah don think say na horse de goat be, de sabi striker don wan climb am befor o. Asin! Shey dem no go kuku buy okada for am so?

We gather say for 2013 when hin tear net against Paderborn naso hin do, even against Hertha Berlin too for 2014. E be like say somtin else don dey dis goat mata.

Hin need go meet de goat for hin house wit fresh carrot to beg am last time wey hin do am for 2013 and 2014.

By Bayo Psalm

No comments:

Post a Comment