Na draw soup(ogbono) almost all teams for Naija Professional Football League use chop food befor dem play Week 1 of NPFL shelement on Satiday and Sunday as five matches end for no settlement of quarrel(stalemate).
For de remaining 4 matches all de home teams show de away teams pepper as dem pack all de 3 points wey dey ground.
But for de match wey suppose shele for inside Owerri wey Heartland and Kano Pillars suppose wear one trouser LMC yarn say na postpone level de match dey becos of de robbery wey shele for Lokoja wey cos make tiff tiff pipu shoot 5 Pillars players.
So na 9 matches shele for Week 1.
For de match wey first shele na so so throway Kwara Utd dey throway goal as Dolphins sef no get beta ginger to score. Naso dem no see de quarrel settle wit any goal till referee fire final whistle.
Na de same tin shele for de 2nd match o for inside de same Liberation Stadium for PH wey Sharks sef no see goal score against Sunshine Stars of Akure and de match end for kondo-kondo.
Victor Yakubu na de guyman wey tear net pass as e take tanda now as de striker score 2 times when Wikki Tourist do Shooting Stars of Ibadan strong tin wit 2-kondo scoreline on Sunday. Na battle of JJC(New comers) be dis o but Wikki head dey dia pass 3SC.
Gabros (dia new name na Ifeanyi Ubah FC) sef na JJC o but e no show at all as dem use de beta swagger wey dem use carry NNL Super 4 kpokpo Warri Wolves. Na Michael Onouha and Onyekachi Nwaiwu helep dem tear net on Sunday.
Eric Frimpong save Bayelsa Utd for inside dem backyard as de guyman equalise for dem inside 70 minute when Obioma Arinze don score for Lobi Stars since first half, naso de match end for 1-1.
Akwa Utd sef no gree make dem settle dem quarrel with Enyimba sef inside Aba upon all de shot wey de Aba wan use baptise Akwa keeper life. Na disappointing result for Enyimba o but Akwa Utd go dey dance shoki go house wit dem 1 point. Na kondo-kondo finish de fight.
Na FC Taraba tear net pass as dem score 3 goals against Rangers wey dem sef shake net 2 times. De Enugu boys really show de swagger wey make dem one of de sabi pass clubs for Naija but dem swagger no reach even draw inside Taraba. 3-2 na hin FC Taraba take open dem season.
Abraham Audu na de sabi master for Kano on Sunday when El Kanemi kpokpo Nasarawa Utd 1-kondo. Giwa FC sef follow Abia Warriors fight am reach 90 minute but no winner as dem play kondo-kondo.
Na JJC Gabros Int'l tanda gidigba ontop table for first o as Wikki, FC Taraba plus including El Kanemi dey follow dem for back as na all of dem gree win dem matches dem.
Na like dis de table take be after Week 1 NPFL:
Nigerian Professional Football League - Table As At
Week 1
# Team P GD Pts
01 Gabros 1 2 3
02 Wikki 1 2 3
03 FC Taraba 1 1 3
04 Elkanemi 1 1 3
05 Bayelsa United 1 0 1
06 Lobi Stars 1 0 1
07 Abia Warriors 1 0 1
08 Akwa United 1 0 1
09 Dolphins 1 0 1
10 Enyimba FC 1 0 1
11 Giwa FC 1 0 1
12 Kwara United 1 0 1
13 Sharks FC 1 0 1
14 Sunshine Stars 1 0 1
15 Heartland FC 0 0 0
16 Kano Pillars 0 0 0
17 Rangers 1 -1 0
18 Nasarawa 1 -1 0
19 Shooting Stars 1 -2 0
20 Warri Wolves 1 -2 0
By Bayo Psalm

No comments:
Post a Comment