Wednesday 25 March 2015

Taribo Dey Hail Enyeama As Goalie Keeper Wey Sabi Pass

Befor befor defender for Super Eagles of Naija, Taribo West, don sonch Vincent Enyeama beta hailings say hin dey one of de goalie keepers wey sabi pass for Naija level as de goalie go dey wear Naija jersey for 100 times when Uganda come chop am.


“From when me sef even dey for Super Eagles naso Enyeama dey shout instructions enta we ear for defense. Hin no even fear say we be hin senior then but de guyman really dey respect us when we don comot for field finish. Na wetin make me know say hin go really do beta for Naija,” West relate.

“Enyeama deserve pass de respect wey hin dey get as he be so becos dis man na one of de goalie keepers wey get sabiness pass for Naija history.”

Taribo later yarn say na hin consistency and sake say Enyeama no dey tire be de secret to hin success, say de goalie keeper don dey do am from 2002 to waka reach 2015

No comments:

Post a Comment