Wednesday 25 March 2015

NPFL: Abia Warriors & Dolphins Go Wear One Trouser (Pidgin)


Abia Warriors go follow Dolphins FC of Port Harcourt knack head today for inside Umuahia by 6pm for match wey dem no gree play for when dem suppose play am becos say Dolphins go do dem different gbege wey dem get for CAF Confed Cup.

Dolphins don come back from Tunis, Tunisia after CAF throway dem comot from inside Confed Cup sake of say dem no reach stadium for time wey dem follow Club Africain tap ball.

Na only one match Dolphins don play dis season and na draw dem play against Kwara Utd. Na de same tori dey for Abia Warriors too but dem don play 2 matches get only one point.

So na beta match we go see for inside Umuahia today as de two clubs go dey find dem first win dis season.

No comments:

Post a Comment