Wednesday, 1 April 2015

TEAR RUBBER: Keshi Yarn NFF: I No Be Slave, I No Go Sign Una Contract!



Oga Stephen Keshi wey be befor befor Coachie for Super Eagles of Naija don yarn all man dis early mormor say hin no go sign de new contract wey NFF carry dash am sake of say hin no be slave.

De coachie don let all man know say all de ngbati ngbati(clauses) wey dey ontop de contract don too much and e be like say na slave NFF wan use am do, plus including say de money wey dem wan give am no do am.

“I don yarn Pinnick last week say make dem find somtin do about all the clauses wey dem pack put ontop de contract unless I no go sign am. But de presido no gree hear my own na why I dey talk am now say I don carry dem papers give dem back o,” Keshi relate.

When amebo pipu bin ask am say weda na money mata no make am sign de contract becos money no make am sign befor sef, naso de coachie para finish com open mouth yarn truth o.

“I no go lie, de money sef no reach me o. De tin too small nah. I no be anybody boy boy. Amaju Pinnick wan turn me to hin slave finish ni? Although I no go let una know how much wey dem put for de contract, but I just wan let am know say I no be anybody slave,” naso Keshi yarn.


Dis one wey Keshi don yarn hin church mind so e be like say Naija go find new coachie to come coach de Super Eagles and we don dey get Claude Le Roy wey dey Congo and Herve Renard wey just carry AFCON for Ivory Coast.

(Na for Oyinbo Oga Keshi relate)


*Na APRIL FOOL TORI OOOOOOOOOOOOOOOO! LWKMD!

*HAPPY NEW MONTH TO ALL OF UNA FROM THE WHOLE CREW OF FUTBALL GALORE.
GOD BLESS ALL OF UNA!

No comments:

Post a Comment