Wednesday 25 February 2015

Plenty Clubs For Europe Don Dey Ontop Nwakali Mata O


Kelechi Nwakali wey dey for Golden Eaglets team and wey be Chidiebere Nwakali junior broad don cos gbege wey dey sweet Naija pipu belle for Europe as hin agent take yarn all man say plenty clubs for Europe don dey fight gidigbo ontop say dem wan sign de small pikin sabi player.


But de agent wey hin name na Klay Ekeocha don confam am say Manchester City don dey toast am wit contract to sign de Naija pikin but hin yarn say if dem go dull demsef say anoda club for Britico or Spain go kolobi de 16-year-old pikin.

“Kelechi na beta sabi player wey plenty clubs don dey get long throat ontop. And dem don dey toast me since ontop hin mata,” Klay Ekeocha relate SL10.ng.

“Manchester City dey ontop hin mata and I don dey follow dem do join body since for months now but no be only City dey ontop hin mata o, even after dat sweet balling wey hin dey do for CAF U17 Championship.

“I don dey follow som other clubs for Britico do join body plus including som of dem for Spain but I no go let una know dem now o.”

Klay Ekeocha don hail Coachie Emmanuel Amuneke wella ontop how hin take coach de Golden Eaglets enter inside CAF U17 Championship.

“Amuneke bin wan carry Naija enter Chile for World Cup and e don happen and I know say na beta dem dey go do for dia.

“So I hail de coachie, hin sabiness plenty and we all for Naija dey proud say we get am. Na beta coachie hin be,” Klay Ekeocha yarn.

Kelechi wey be say na Diamond Academy wey dey Umuahia get all hin paper and ngbati for hand don tear net for all matches dem for inside CAF U17 Championship.

No comments:

Post a Comment