Thursday 26 February 2015

Amajimbos Na Golden Eaglets Bus Stop

Na Eric Mayo be de guyman wey score de goal wey mark bus stop for de Golden Eaglets of Naija to take alternative route enter 3rd place match of African U17 Championship instead of de final. Na dat one goal de Amajimbos of Southy use kpokpo Naija.

Naso de two teams take start de match wit fire for fire as notin really consine dem wit defense, dem just wan attack.

Sharp sharp for inside early mormor of de match na hin Southy don dey knock ontop goalie keeper Akpan Udoh door wey hin no gree open for dem.

Naija sef no dull as Suleiman Abdullahi sef budey hin own shot but e no enter.

For inside 11 minute, Victor Osimhen get awoof chance to score but de guyman too slow for post front naso hin dull hinsef.

Osimhen still get anoda chance five minute later, hin try dis time but de goalie keeper Mondli Mpoto show am say hin no carry mat come sleep for post.

Mpoto let Naija know say dem go need follow Amadioha yarn ontop hin mata befor dem go fit score as save Okonkwo chance again.

Na for inside 26 minute de horror film wey all Naija pikin bin dey fear to watch happen o as Mayo find beta place for post keep de ball and Southy lead 1-kondo.

As e remain 5 minutes make first half pack load comot naso Kelechi Nwakali and Osimhen start to dey show Mpoto hard time but de goalie tanda gidigba save all dem ball.

Naso de Amajimbos take finish first half as oga boss.

As 2nd half begin Mpoto na still dat winchy for Naija o as hin let any ball still pass am for post.

Naso Southy just dey gather confido dey go for inside de match like garri inside water wey dey swell.

Golden Eaglets coachie Emmanuel Amuneke sha later think say na anoda attacker go make de game gel wella naso hin talk say make Christian Charles wear jersey enter match.

When e remain 13 minutes make match finish naso Chukwueze Samuel throway one-on-one wey Naija suppose use equalise.

De guyman get anoda chance o. Dis time hin mumu 3 defenders but hin no fit finish wetin hin start has hin fire de ball hit anoda defender.

Na all way Golden Eaglets try to get equaliser but Mpoto just do strong head through out, even when Osimhen try hin bicycle kick..
 
By Bayo Psalm
 
About the writer: He is an undergraduate based in Ilorin, Kwara State.

No comments:

Post a Comment