Players and fans for Naija Women Football League don dey para say dem no wan chairperson of NWFL Chief Mrs Dilichukwu Onyedinma make she continue.
Dem say de whole league don kpafuka since she start as chairperson for de league and she too dey involve for NFF politics wey no dey let her dey get time chook eye for league mata.
"We no want her again o. We league no make sense again and plenty gbege don dey ontop organization of de league since. Imagine say we never even start league by now sef. She too like to dey chook eye for NFF mata," naso one player wey really dey para wey we no go give una hin name yarn.

"Shey una notice de kain yeye congress wey shele for Abuja? And she no even com present cup to River Angels after dem kpokpo Confluence Queens. Na de kain chairperson wey she be be dat. We want change o. Now wey Buhari don chop Naija presido we want anoda pesin for NWFL," Naso de player finish am.
*Na APRIL FOOL TORI OOOOOOOOOOOOOOOO! LWKMD!
*HAPPY NEW MONTH TO ALL OF UNA FROM THE WHOLE CREW OF FUTBALL GALORE.
GOD BLESS ALL OF UNA!
No comments:
Post a Comment